Pastor for Obodo Ghana don land for cell wey rape 13-year-old pikin
Pastor for Obodo Ghana from Domeabra for the GA West Municipa Assembly don drop for inside cell for 20 years with plenty work for raping 13-Year-old girl. The clergy man wey we sabi een name as Vincent Kete beg say na him rape the pikin of him Friend of 25 years.
When the Judge dem de hear the case, the person wey de question am hin name na Kofi Atimbiri said the Clergy man say make the victim waka come him room on Tuesday, February 7, 2016 and hin con rape the pikin.
The pastor now and the victim papa, wey dem be friends, de sit down for single room in the mission house wey the church been get. The Clergy man open mouth for the Accra court wey Magistrate Abena Oppong Adjin-Doku de judge matter blame devil wey no get anything do with hin matter and he con yarn say hin no sabi wetin come ontop am.
After all the crocodile tears dem still send the clergy man to 20 years in cell and hin go de do hard work
source: Linda Ikeji and 3news

Comments
Post a Comment