I see this Gist for one side, i just say make i share am with una
E sweet Zazu for belle nor be small, as Sunday vanguard send their tory persin, Morenike Taire make she come do small akproko, yarn with our own oga patapata for pidgin talk; Victor Ehikhamenor.
She begin dey hail di bros as ogbonge artist wey get mouth inside draw draw wey im dey do for Oversea, wey still get mouth for writing runs sotay im come arrange dis pidgin racket wey be zazugist.com.
Di babe try for her gist sha. When you don read di grammatica wey sometimes dey dance commot for concord, you go understand say dis broken wey we dey speak na yarns wey first start for waterside, those areas wey oyinbo from enter we country, like Warri, Port- Harcourt, Sapele. Na people for dis areas begin remix oyinbo man English, as dem dey try learn am, sotay we come get different kain pidgin today. Even Sierra Leone get their own pidgin wey be creole.
Inside di yarns we still read say pidgin, or broken na wetin you go hear for any corner wey you chook head for Naija. If you carry waka enter Aba and you nor dey hear Ibo, wetin you go knack for market when you wan buy sontin? Na broken!
As I read di gist dey go naim I see say di babe wan baptize us again; abeg o, we nor be zazunews .com! We be zazugist.com, so diafore, any newspaper wey try change our name- Holy Gh-ost Fire!
Di babe even ask whether pidgin get special arrangement, dat na wetin oyibo dey call structure. Structure na one ting wen get accident for her tory sha. Some lines dey read like wetin dem delete half remain. Well, wetin Zazu sabi? Shebi na only pidgin paroles I dey run.
Our bros kukuma finish di gist when im yarn say na bicos oyinbo never put broken for inside big book, give am big name, naim make we dey look am like wetin nor make brain. Say any language wey people go hear, sabi wetin e mean, di language must to get how dem dey take arrange am, odawise, people nor go understand wetin we dey yarn. Pidgin get correct structure.
Oga Victor yarn say as pidgin be wetin all we country people dey take gist, na we get to still yarn people about am. Na dis ting ginger am to start zazugist.com, make e for be like market where people dey gather to do different amebo. Some people go dey buy, odas go dey look, odas go dey runs akproko, some go still learn new tings for dia, for inside we opidgionary, plus oda echeteram tings wey zazugist.com go still carry come.
After all if French fit be language of love, why pidgin nor fit be language of happiness?
Abeg, three gbosa for us (and Sunday Vanguard) jor!

Comments
Post a Comment