171 Of Our Obodo Naija People Don Waka Come From Libya
One of our people wey waka come back, her name na Gift Peters, she talk say wen she land for libya some 11 months ago, after ee be like say dem don whine am say she de go Germany, yarn say;
"When she waka reach Libya, the thing no de her mind again make she de continue the journey. So she yarn the person wey carry am go say biko, make baba return am go back Naija , but hin start to de maltreat am, con sell am to another person we get one kind connection house for Libya where dem de maltreat people on a normal".
She con yarn say if dem no work, them go start to de beat dem, de frustrate them. them go wan make you die.
When dem sell them to another person, those ones nao go con use iron de burn them. At times, they go command other ladies make them Urinate make dem drink."
Our people de suffer Obodo over there o.



Comments
Post a Comment