18-year-old daughter of Ghanaian politician don kill herself onto say she fail course for school.



Adwoa Agryarkwa, wey be daughter of Kwame Anyimadu-Antwi, hin be member of NPP Member Parliament for Akyem central constituency, don hang herself, the omote wey be 18 years old and na her first year for chemical engineering at the Kwame Nkrumah University of Science and Technology (KNUST). Her people dem waka come meet am con see say she don delete on Friday for her hostel with rope wey de around her neck.
I de wonder how many of our Naija people fit kill themselves on top say dem fail course.
Na from source wey de the campus wey tell us say she fail course for school and she de shame for body.
Before she delete , the omote con drop note for her con yarn say "make una no vex, Mile and Pile".
Dem don drop the fine pikin for mortuary for Kumasi, Ghana.

Comments

Popular Posts