2 baba Don cancel we no go gree waka

As 2 baba wey be celebrity don yarn say hin no go wan do the we no go gree cos of say Dem people wey de protect us de warn am say make hin no just try am say dem go use hin eye see something if hin try am. Our people for Obodo Naija come de call 2 baba say why hin go cho for matter wey hin arrange for ground but e just be like say baba no want trouble.


But as e de hot na from tomorrow people for Abuja go start the we no go gree against our presido, Sai Baba , wey never sho from Obodo yinbo cos as ee be people don tire, dem say dem no do again, dem wan make Sai Baba answer them wetin de happen for this our Obodo.
Seyi law wey be comedian don yarn say 2baba or no 2baba say hin go start the we no go gree via hin twitter and hin sef don tire for this our Naija mata.
Our Obodo people sef for twitter yarn say dem sef go full ground tomorrow do we no go gree too



But as ee de hot we go sunch una update onto the matter. We is coming back.




Comments