EFCC don carry one Babalawo cos of N2.4m fraud
As e be on top this new matter, EFCC, on Wednesday, February 22,2017 arraigned one man for court hin name na Bala Tangalu and na One Justice A.B. Mohammed of the Federal Capital Territory High court wey sitdon for Jabi, Abuja. Dem bin charge am onto Conspiracy and say hin de claim person wey hin no be and efritin con amount to N2.5m. Tangalu, wey de pose as Babalawo, don enter EFCC net and na one Dozie Ugonna, wey raise the alert say dem the Babalawo and him people don scam of N2.5m. Only God knows wetin hin de find there, wetin hin wan de tell the court now?.
But as e be now, the person wey go the court con yarn say the money wey hin give the babalawo na to purchase materials for to neutralise charm wey de one carton wey plenty U.S Dollars de inside. My people abeg this tory no pure, how hin take get container wey full with dollars.
The court People with their own talk con de quote the law say, (make i just yarn am unfiltered)
But as e be right now, the coucel to the accused, Yusuf Abdullahi, don yarn the court say hin get bail wey de on hold before the court.
Justice Mohammed con grant am bail con talk say N2m go de with another two sureties wey also gey the money. the two sureties gas be civil servant or must be community leader. Dem do shift the case waka go March 20, 2017 for trail.

The offence is contrary to Section 8 (a) and punishable under Section 8 (C) and 1 (3) of the Advance Fee Fraud and Other Fraud Related Offences Act No. 14, 2006. Particulars of Count two read:
“Bala Tangalu, Ataye (still at large), Nnamdi (still at large) Peace (still at large) and Linda (still at large), in the year 2016 at Abuja within the jurisdiction of this Honourable Court with intent to defraud obtained the total sum of N2,540.000 (Two Million, Five Hundred and Forty Thousand Naira Only) from one Dozie Ugonna under the pretence that you are a native doctor a.k.a Babalawo and the monies were for purchase of materials to neutralize some harmful charms contained in a carton filled with United State Dollars, which pretence you knew to be false".The Babalawo talk say hin clean like new toilet for onto the matter. After hin don beg, councel to EFCC, Eizabeth Alabi, yarn the court say make them fix date wey dem go use do trail and talk say make the accused sleep for cell until when the trail reach. She con also tell the court say make dem look the offence wen hin commit say na least wey hin fit go jail na like seven years.
But as e be right now, the coucel to the accused, Yusuf Abdullahi, don yarn the court say hin get bail wey de on hold before the court.
Justice Mohammed con grant am bail con talk say N2m go de with another two sureties wey also gey the money. the two sureties gas be civil servant or must be community leader. Dem do shift the case waka go March 20, 2017 for trail.

Comments
Post a Comment