Pele pikin de push go cell after dem nab am de do drugs and hin de move money.



Una remember Pele, wey be Legend for Brazil. Well as e de hot, One court for Brazil don tell hin son make hin de push enter prison because say dem nab de de do drugs and say money de waka under am. The court dem talk say na like 13 years wey hin go sleep for cell. Edinho, wey hin name na Edson Cholbi do Nascimento bin don get one sentence before wey be 33 years in 2014. But dem con de beg on top  the matter, so the pikin no con serve the sentence again, until the court arrange matter  for ground, dem con talk say this new sentence go be 12 years and 10 months and na on Friday, February 24,2017 dem con tell am wetin be the outcome.
Edinho in order to keep hin rep na, con yarn say hin de innocent and hin go continue to de fight wetin de happen to am hin also talk say evidence no de against am and e de painful.

Comments

Popular Posts