Fayose do yarn FG say hin no go ban Okada for Ekiti
The Ekiti State Governor join as Chairman of the Peoples Democratic Party (PDP) Governors’ Forum, Mr Ayodele Fayose don yarn say plot by the federal government to ban okada in the country de harsh, he yarn say;
“In this state, we no fit ban Okada because say nasource of livelihood to many families. Why person go even think such thing when government no create another employment?.With this Buhari thing wey de bite for body, na wicked thing make the federal government send Okada riders comot instead of putting movement to check wetin dem de do.”According to yarn on Sunday, by hin Special Assistant on Public Communications and New Media, Lere Olayinka, Governor Fayose, who de follow Okada riders yarn, wey follow am reason in Ikere Ekiti, wen hin de waka come from Abuja on Saturday,yarn say “ make Okada comot go worsen Obodo Naija security situation because say e go remove chao from plenty people table.”
The governor, con promise Okada riders for Ekiti State yarn say hin de their back;
“The federal government no get power to ban Okada for my State while hin get two eyes, no one go stop Okada Riders to de waka as far as say dem no waka against the law.”
“The hunger wey de the land de kill and them Okada riders be graduates wey don start okoda make dem live because say job no de. Many of them don lose their job ontop the 21 months of this Sai Baba led federal government and government workers, wey dem no de pay salary on a normal. how the federal government wan make dem chop if their means of livelihood don waka?
“If Okada de cause fatal road accidents for the country, wey the federal government talk, na to ban them be the next thing? “So make motor vehicle, especially heavy duty moto comot our road because say dem de cause accidents?
“Make the federal government concern hinself with the way people no get job for the country and the road wey don baje, especially federal roads, instead of make dem de deprive people, who don de ride Okada make dem save themselves join with their families make hungry no kill dem.”


Vsparalol-so Roy Reese Download
ReplyDeletestapinhydon
OprobcaWpropmi Amanda Duarte Programs
ReplyDeleteFixMeStick
MobieTrans 2.2.6
click here
ricstydedi