ICPC been de find person wey do yahoo-yahoo
As you de see this person so for this picture hin name na DAVID KENNEDY PETER, the Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) don yarn say dem need this man because say hin join body do fraud. The Mr.David, na Orumba North Local Government person wey de for Anambra state, dem yarn say hin skin colour na dudu and dem born am for 31st December 1986 (30 years).
hin been de stay for NO.55 ifite Road, Awka, Anambra State.
Anyone wey sabi where this bros de , make hin waka go ICPC Headquarters Abuja, any of the ICPC State Offices or the nearest Olopa station, or yarn dem for phone ICPC Toll-Free lines: 0803-123-0280, 0803-123-0281, 0803-123-0282, 0705-699-0190, 0705-699-0191 and 0800-CALL-ICPC (0800-2255-4272)

Comments
Post a Comment