CHELSEA VS MANCHESTER UNITED PREVIEW

As e be like this so na Chelsea vs Manchester United wan kick ball this night and as e be the whole world go de chook eye for inside this one as na the hottest quarter final match for the FA Cup for obodo England, and na for Chelsea house wey be Stamford Bridge wey dem go play this match and we go stand de watch this one live follow us ontop our Twitter @PidginYarn for live Tory. As e de hot. We go update you on full time result and wetin happen for the match after.
From werin we do sabi for  Stamford Bridge Chelsea no get any injury and na the first team go play and ManU no get any Striker as all of them don cancel for the match except for Ibra wey hin flex muscle on one defender for Last match and dem ban am well.
Naira bet and Bet 360 don talk say na Chelsea make you put your money on Nd we go do just that. We believe say Chelsea fit score like 3 goals. Make we see as e be
#ASHEDEHOT

Comments

Popular Posts