Chelsea vs ManU post match

Well well we don see as the match go and na good match with plenty action from both teams.
For the start of the ball ManU be wan flex muscles as dem manage get one corner but na luiz block am comot. ManU be wan start to de press but Chelsea just de pocket them anyhow
The first chance na wen Chelsea don settle into match and Hazard dance pass all ManU defenders con shoot OP.
Action no con de until towards the End the first half wey Herrera chop red card. After hin don nearly delete Hazard for the second time.
ManU con bring Fellani make hin replace that man dem de call mhikitarian who don already try for the match.
Na so the first half end with ceaser trying some long range shot e no de disturb degea.
Second half con show and Chelsea con de play Manu half field as ManU de park Trailer for post. But na  that Man wey him name na Ngolo Kante, naim con shoot ball from ourside box after one pass from willian and DeGea con stretch himself but hin no fit reach the ball Into the left bottom corner
Chelsea continue to de press with Willian and Costa missing the target by few inches and Hazard just be like the devil wey de torment ManU players.
Rashford show small of why hin good after hin don turn cahill like eba but na courtois just manage block the shot.
Fabregas later shoot one kin shot wey weak like prison tea and na so the match take end with Chelsea 1 and ManU 0
Chelsea 72% possession to ManU 28%
Kante na man of the Match and Man of the moment.

Comments

Popular Posts