Efe our very own warri boy don win 25 milla

Image result for efe bbn
Our very own waffi person don collobi the 25 million wey dem promise am if hi go win the big brother Naija . The boy don de the house for 77 days and we like am on to say the boy na real G, na always pidgin hin de speak, hin de always talk true. Hin no de live fake life. Nigerians sef con like am cos say na humble person with Humble Background and everyone de like associate himself with am. We go like see wetin hin use the money do, and we for here de wish am luck for everything wey hin do.
Hin fight off Bisola, wey Nigerians no go vex if na she win am, Tboss, Mavis, Debbie Rise.
Congratulations Mr. Based on Logistics.

Comments

Popular Posts