New year prayer for you
So as we de start this new year. i just wan make you na know say God de your front. He de dere to help you , no be say na play. Just de waka de find God, no how no how wey Baba no go show. Just de hope de Believe.
But as e de hot now, your enemies go wan de do anyhow, de carry shoulder up, de block your Sunlight, make any person wey be enemy of progress, fall down and delete, dem no go succeed, dem go see you de make am, and them no fit do norring. All of them go see your shining star and e go blind dem.
Who ever talk say your chao no go done, he own firewood no go catch fire.
Who ever talk say your water no go boil, he kettle no go hot.
Who ever talk say your banga no go ripe, he own no go grow.
Who wan do you anyhow this year no go just fit try am.
I don anoint you, make una go well.
make una come de read my tory. ooo
Happy new year.
Jhudeeh
Nice one Jude
ReplyDeleteKeep it up